Leta di messenjas kom back to King Ahab sey King Ben-Hadad still dey ask for anoda tin, “I bin sey make yu give mi all yor silva and gold, yor wimen and shidren.
So di pesin wey dey look di palis, di leader for di town, di eldas and di guards kon send dis message go meet Jehu sey, “Wi bi yor savants! Wi go do anytin wey yu tok. Wi nor go fit crown anybody. Make yu just do wetin yu know sey dey good.”
“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.
una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.