Israel sojas kon porshu Siria sojas go back. David with en men kill 7,000 war horse-men and 40,000 sojas wey dey waka with leg. Dem still kill Shobak wey dey kommand Siria sojas.
One profet go meet King Ahab kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Bikos Siria pipol tok sey I bi god for mountin and nor bi for groun, I go make yu win dia many sojas and yu and yor pipol go know sey na mi bi God.’ ”
Doz wey survive run enter Afek town where di town wall fall press and kill 27,000. King Ben-Hadad still run enter di town and e hide for di back room for one house.
kon sey, “Make yu open di window face east.” So di king do as di profet tell am. Elisha kon sey, “Make yu shot!” So di king kon shot. Elisha tell am again, “Dis arrow mean di viktory wey God won give yu ova Siria king and en pipol. Yu go distroy Siria for Afek!”
Jehoash wey bi Jehoahaz pikin kon kollect all di land wey Ben-Hadad papa, Hazael, don take from en papa hand for war. Jehoash win three times kon kollect all di land and towns wey bi Israel pipol own.