1 Kings 20:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
22 Den di profet go meet King Ahab kon sey, “Make yu go back go train yor sojas kon make plan, bikos Siria king go attack una again for di next rainin sizin.”
Before dry sizin, for di time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipol sojas and dem defeat Ammon pipol kon take-ova Rabbah town. But David stay for Jerusalem.
E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
One of dem ansa, “My king, dat kind tin nor fit happen. Na Profet Elisha for Israel dey tell di king evritin, even di words wey yu dey tok for inside yor bedroom, e dey hear am.”
Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town.
My God, even doh Yu don dey ready to ponish wiked pipol, dem nor still know sey Yu won ponish dem. Dem go si am and shame go katch dem wen dem si how Yu go take judge yor enemies for di world.
Dem go distroy di town kon skata evriwhere! So make una listin, all di far-far land for di eart. Make una dey ready to fight, but dem go still distroy una!