Ahab ask, “Who go lead for di attack?” Di profet ansa, “God sey make e bi di yong sojas wey di district govnor dey kommand.” Di king kon ask, “Den who go kommand di main sojas?” Di profet ansa, “Na yu.”
King Jehoahaz nor get any sojas, escept fifty men wey fit use horse, ten shariot and 10,000 sojas for groun. Siria king don kill and mash all en men like san-san.
King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.”
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”