E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”
Yu, yor shidren and yor savants go work for di land wey bi yor oga family own kon harvest and provide food for Mefiboshet family. But Mefiboshet ensef, go always kom chop for my tabol.” Ziba get fifteen shidren and twenty savant.
David tell am, “Make yu nor fear. I go dey kind to yu, bikos of Jonatan wey bi yor papa. I go give yu evritin wey bi Saul, yor grand-papa own and anytime wey yu kom my tabol, I go welkom yu.”
Dis na some among di priests family wey dem nor fit show sey dem bi Israel pipol: Hobaaya, Hakkoz, Barzillai (wey marry one of Barzillai dotas, wey bi Gilead pesin and e kon dey ansa en fada-in-law name.)
Make yu nor forget yor friends or yor papa friends, bikos if yu dey trobol, yu nor nid to ask yor relashon for help. Di neighbour wey dey near yu, fit help yu pass yor relashon wey dey far.