For early morning di next day, Abraham kon get up go ready en donkey. E take two of en savants follow body plus en pikin, Isaak. Wen e don kut di wood for di ofrin, e kon bigin go di place wey God tell am.
Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.