4 If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”
but I go let Solomon pikin keep one tribe, so dat my savant David, shidren-shidren go fit dey rule for Jerusalem, di town wey I don choose sey dem go for woship mi.
kon pray, “Di Oga wey bi Israel pipol God; e nor get any god wey bi like Yu for heaven or for eart! Yu do wetin Yu promise yor pipol kon show dem yor love, bikos dem obey Yu with dia whole heart.
And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu.
“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.
Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.
Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.
My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’
God go gada all di nashons go fight Jerusalem. Dem go attack di town, tif evritin from all di house, den rape di wimen. Dem go karry some of di pipol go anoda land as slave, but dem nor go take evribody komot from di town.
Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.