Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 2:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 If yu ever pass Kidron Valley, yu go die and di blame go dey yor own head.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 2:37
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”


All di pipol for di town bigin kry as David with en men dey go. Di king with en men wey dey follow am kon cross go Kidron Valley as dem waka face di wildaness.


E remove en mama Maaka, as kween moda, bikos e dey serve Asherah juju. King Asa skata di juju kon burn am for Kidron Valley.


So, Solomon ansa, “Make yu do as e tok. Kill and beri am, so dat dem nor go hold mi, yu or any oda David pikin for wetin Joab do wen e kill innocent pipol.


Dia blood go dey for Joab and en shidren-shidren head forever. But God go make David and shidren-shidren prosper for en throne forever.”


Shimei ansa, “Okay my king, I go do wetin yu tok,” So Shimei stay for Jerusalem for long time.


E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.


Di priest enter God house kon make am holy. Evritin wey nor dey klean for God Temple, dem karry am go out and Levi pipol kon karry dem go Kidron Valley.


All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”


and dey borrow pipol money to make gain. E go fit live? No! E nor go live. E don do all dis bad tins, so e must die and e go blame ensef for en own deat.


“ ‘If anybody curse en papa and mama, dem must kill-am and en blood go dey en own head, bikos e curse en papa and mama.


Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.


Anybody wey kom out from yor house, na-im kill ensef bi dat, so dat one nor go bi awa fault! But if anytin happen to anybody inside yor house, den make yu blame us.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ