So dem chop and drink as dem dey happy for God present. Den dem kon dey shaut, “Na Solomon bi king.” Den, dem anoint am with God name as dia ruler kon make Zadok dia priest.
while di one wey face nort, na for di priest wey dey serve for di altar. All di priest na Zadok shidren-shidren; na dem bi di only pipol for Levi tribe wey fit go serve God for inside en temple.”
Doz priests wey kom from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren, na only dem go fit kom inside my present kom serve mi. Na mi, wey bi God wey get pawa dey kommand yu. Yu go give dem one yong melu make dem offa as sakrifice for sins.
Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.