6 As e look, e si bread and wota for bottol near en head. E chop di bread and drink wota, den e sleep again.
Di valley go bring out wota wey yu go drink and I don kommand birds make dem bring food kom give yu for der.”
E dey drink wota from di valley and birds dey bring bread and meat kon gi-am evry morning and evening.
E kon sleep under di tree. At wons, one angel tosh am kon sey, “Make yu stand up kon chop.”
God angel wake am di sekond time sey, “Get up make yu chop, bikos di waka wey yu won waka so, hard well-well.”
Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
one woman bring kontaina wey get oil wey dear well-well kon pour di oil for Jesus head as e sidan for tabol dey chop.
So, devil kon leave Jesus and God angels kon bigin help am.
Na dis kind tins pipol wey nor know God dey porshu and una Papa for heaven know sey una nid dem.
Jesus kon ask dem, “My shidren, una katch any fish?” Dem ansa, “No o-o.”
Wen dem don kom down from di kenu, dem kon si shako fire with fish and some bread on-top am.