5 E kon sleep under di tree. At wons, one angel tosh am kon sey, “Make yu stand up kon chop.”
as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”
As e look, e si bread and wota for bottol near en head. E chop di bread and drink wota, den e sleep again.
Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
Bikos na God angel dey guide mi, na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.
So e sey, “I kom tell yu wetin go happen wen trobol go dey for di world. Dis vishon na about wen di world won end.
Angel Gabriel wey I don first si for my vishon before kon dey fly kom where I dey. Dat time, dem won offa di evening sakrifice.
Den di angel wey bin dey tok to mi kom back kon wake mi just as dem dey wake pesin wey dey sleep.
God angel appear and lite kon shine for di prison. Di angel wake Pita kon tell am, “Get up kwik-kwik!” At wons, di shains fall komot from Pita hand.
All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.
Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”