Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 19:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 19:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

follow and meet di profet wey kom from Judah under one oak tree where e sidan. Den e ask am, “Na yu bi di profet wey kom from Judah?” Di profet ansa, “Yes! Na mi.”


Elijah kon dey fear, so e run go Beersheba for Judah. E leave en savant for der,


E kon sleep under di tree. At wons, one angel tosh am kon sey, “Make yu stand up kon chop.”


As dem dey waka dey tok dey go, one shariot with fire kom out at wons kon separate dem two. Den strong breeze kon karry Elijah go heaven.


“Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?


I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.


But wen I sey, “I go forget God and I nor go tok with en name again,” na dat time yor message dey bi like fire wey dey burn inside my body. Even wen I try to pritend sey nor-tin dey happen, I nor dey fit.


Make una go si wetin happen to Kalneh land, den pass der go Hamat-Rabbah and Filistia pipol town for Gat. Una nor si as dem distroy dem, abi una betta pass dem?


So my God, make Yu just kill mi. E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”


Wen sun start to shine, God kon send one hot breeze kom from east. Di sun dey shine for Jonah head and e nearly faint. So as Jonah dey vex, bikos di plant wey kover en head don die, e kon sey, “E betta make I die, dan dis life wey I dey live so.”


Nineveh, una betta pass Tebes town near River Nile? Na di river bi di wall wey dey protet am.


E betta sey make Yu kill mi, dan sey make Yu dey trit mi like dis. If really sey Yu dey good to mi, den make Yu allow dis trobol pass mi.”


Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?


Jakob well dey der too. Dat aftanoon, bikos Jesus don taya to waka, e kon sidan near di well.


So wetin wi go tok? Wi go sey na wi wey bi Jew betta pass? Dat na lie! Bikos as I don already show una, Jew and Gentile pipol dey kommit sin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ