Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 19:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Elijah komot from der kon si Elisha, wey Shafat born, dey work with twelf melu for en farm. E sidan on-top one, while eleven dey en front. Elijah remove en own klot kon use am take kover Elisha body.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 19:19
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As e hear am, e kover en face with en klot kon waka go di kave door-mot for outside. Den one vois tell am, “Elijah! Wetin yu dey do for here?”


Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu.


Elijah use en garment nak di wota and di wota divide into two. Den, two of dem waka pass for dry groun.


One day wen Moses dey kare for di sheep and goat wey bi en wife papa, Jetro wey bi priest for Midian own, e kon karry di animals go far for anoda side for di wildaness till e rish di holy mountin for Horeb.


Amos ansa, “I nor bi profet before and I nor bi profet pikin. Na shepad I bi and I dey kare for fig trees.


But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.


Instead, e go sey, ‘I nor bi profet. Na farmer work I dey do since my mama born mi.’


Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow.


Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am.


Naw, Saul just dey bring en animals kom back from farm. Wen Saul si di pipol, e kon ask, “Wetin happen? Wetin make una dey kry?” Dem kon tell am about di men for Jabesh.


Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ