Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”
Di gateman kon go tell di king again sey, “I send anoda pesin go, but e neva kom back. But di pesin wey dey lead dis men bi like Jehu and e dey ride kom with speed.”
Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,
God still sey, “Anybody wey try eskape di wahala go fall enter di pit and anybody wey fit kom out from di pit go enter trap, bikos God don set di time wey dem go distroy and skata Moab.
Na dis make mi send my profet kom give una di judgement and distroshon message. Just as day dey break for morning, na so too, my judgement go kom meet una.
E go bi like pesin wey run hide bikos of lion, but where e hide put or run enter, na tiga e go meet for der! Or like pesin wey run go hide for house, but as e put en hand for wall, snake kon bite am!