Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 18:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 18:40
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Elijah tell King Ahab sey, “Make yu go drink and chop, bikos yu go soon hear heavy rain as e dey kom.”


King Ahab tell Jezebel all wetin Elijah do and how e kill all di Baal profets with en swod.


Di pipol kon go skata dia juju, di juju house dem and en altar. Dem kill Mattan wey bi di juju priest for di altar front. Jehoiada kon put guards for di Temple.


Dem seize Atalaya, karry am go di palis kon kill-am for di horse gate.


All di pipol kon go distroy di juju temple. Dem skata di altar with all di juju wey dey inside. Dem kill Mattan wey bi Baal priest for di altar front.


“Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.


(Pesin wey nor do God work with all en heart, na curse go follow am and na di same curse go follow who nor bring en swod kom out to take kill!)


But for di profet and doz wey dey si wetin go happen, make una kill dem, bikos dem won make pipol sin against di Oga una God wey take una komot from Egypt where una for bi slave. Una must kill dem, bikos dem dey try to deceive una komot from di way wey God wont make una follow. So like dis, una must skata and distroy evry bad tin or pipol wey dey among una.


Weda na una broda, pikin, wife or friend kon tok and wont make una serve oda gods wey una or una grand-grand papa nor know before,


But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.


So dem seize di beast and di fake profets wey dey help am do mirakles to deceive pipol wey kollect di beast mark and woship en image. Den dem trow dem two inside di fire wey sulfur dey and di fire burn dem alive.


Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.


e koll en 900 iron war horse and en men, den dem mash komot from Haroshet-Haggoyim go Kishon River.


And I go bring Sisera, kommander for Jabin sojas, with en war horse and warrior kom Kishon River and for der, I go give una viktory ova am.”


Kishon River karry dem go. So I go mash face dem with full force!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ