Una go koll una god name and I go koll my God name. Den, di one wey go ansa with fire, na-im bi di true God.” All di pipol ansa, “Dis test na good one.”
E build altar for der for God kon do burnt and fellowship ofrin for di altar. E pray and God kon ansa am, bikos E send fire from heaven kon burn di sakrifice for di altar.
As e still dey tok, anoda savant run kom kon sey, “Oga! God fire fall kom from heaven kon kill all di sheep and doz wey dey guide dem and na only mi one eskape kom tell yu.”
Dia king go run komot from en palis bikos of fear; dia ofisas go dey fear wen dem si God war flag.” Dis na God word; di One wey en fire dey burn well-well for Mount Zion.