Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.
Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.
Wen dem nor si dem, dem kon drag Jason and some for en brodas go meet di town oga, dey shaut, “All dis pipol wey don start wahala for di world, don rish here too
Bikos wi don si dis man sey e find trobol and kause wahala among all di Jew pipol for di world and naim dey lead di gang wey dem dey koll, ‘Di Nazarenes’.
Joshua kon sey, “Wetin make yu bring wahala for awa head? God go put wahala for yor head today!” So, evribody for Israel stone en, en family and evritin wey e get until dem die finish, den dem kon burn dem.