So, King Zedekaya kon sey make dem lock mi for di kourtyard wey dey di palis. I stay for der and evriday, dem dey give mi bread chop, until all di bread for di town finish.
But naw, I dey take di shain komot from yor hand kon free yu. If yu like follow mi go Babilon, no problem! I go kare for yu for der. But if yu nor won go, yu fit choose anywhere wey yu wont, den make yu go der.”
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.
Samson tell dem, “Di pesin wey chop, na-im dey bring wetin dem go chop and na from wetin strong, sweet tin for dey kom out.” Afta three days, dem neva still fit solve am.