23 Elijah karry di pikin go down kon tell en mama, “Si, yor pikin don kom back to life!”
God ansa Elijah prayer, so di pikin kon kough and start to breath again.
Di woman ansa, “Na naw I know sey yu bi God savant and God dey really tok thru yu!”
So di man get up kon start to tok. Jesus kon gi-am back to en mama.
Wen e don near house, en savants kon meet, tell am sey, “Yor pikin don well, e nor die.”
Pita kon hold en hand stand up. E koll di bilivers and all di wimen wey dia husband don die, kon give di woman to dem.
Some wimen wey dia pipol don die, na faith make dem receive dem back, alive. Some pipol rijet freedom kon die for sofa, so dat dem go fit wake-up from deat and enter life wey betta pass dis one.