19 Elijah tell am, “Make yu give mi di pikin.” Elijah karry di pikin from am, klimb go di room wey e dey stay for up kon put am for bed.
Di woman go meet Profet Elijah kon sey, “God savant, why yu do mi dis kind tin? Yu kom here kon make God remember my sins, den kill my pikin?”
Den e shaut kon pray, “My Oga God, why Yu allow dis kind bad tin happen to dis woman? E dey kind and dey kare for mi! Naw, Yu don allow en pikin die.”
so make wi make one small room for up kon put bed, tabol, chair and lantan for der, so dat wen ever e kom, e go stay here with us.”
So di woman karry di pikin dead body go put for Elisha bed for up kon komot der.
Wen Elisha rish di house, e kon si di boy dead body for en bed.
E sick and e kon die. Wen di pipol don wosh en dead body, dem kon karry am put for one room for upstair.