16 As God don promise thru Elijah, flower and oil nor finish from di woman plate and cup.
Di altar fall and di ashes kon skata, just as di profet tok with God name.
So wetin God tok against Baasha thru Profet Jehu kon happen, bikos Zimri don kill evribody for Baasha family.
Di woman kon go do wetin Elijah tell am and all of dem si food chop for many days.
Afta sometaim, di woman pikin kon bigin sick. Bikos di sickness strong well-well, di pikin kon die.
Just as God sey e go happen, dem wosh di shariot for Samaria pool where ashawo for dey baf, den dogs kon dey lick Ahab blood.
Di king die just as God tok thru Elijah. For di sekond year wey Jehoshafat pikin, Jehoram bi king for Judah, Ahazaya broda wey bi Jehoram kon bi king for Israel, bikos di former king nor born boy at-all.
So Naaman go wosh ensef inside Jordan River seven times, just as God profet kommand am. Afta di sevent time, en skin kon smooth like small pikin own.
Jesus look dem kon ansa, “E nor possibol for human being, but evritin dey possibol with God.”
one woman bring kontaina wey get oil wey dear well-well kon pour di oil for Jesus head as e sidan for tabol dey chop.
Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”
And God don bless yu, bikos yu bilive sey wetin E tok, go happen.”