For di twenty-sevent year wey Asa don bi king for Judah, Zimri kon rule Israel pipol from Tirzah for seven days, wen Israel sojas dey take-ova Gibbeton town for Filistia
So for di thirty-first year wey Asa don dey rule Judah, Omri kon bi king for Israel and e rule for twelf years. Na from Tirzah e for rule for di first six years
Na God give Profet Jehu di message wey e tok against King Baasha and en family, bikos of di sin wey dem kommit. Nor bi only en wikedness dey make God vex, but na bikos e kill evribody for Jeroboam family.
Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der.
Amon na twenty-two years wen e start to rule and e rule from Jerusalem for two years. En mama name na Meshullemet and na Haruz wey kom from Jotbah, born di woman.