Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”
So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?” Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.
instead, yu dey sin like Israel kings. Yu make Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem turn from God, just as Ahab family do for Israel. Yu still kill yor brodas and yor papa family wey betta pass yu.
E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.