But Leah ansa, “So my husband wey yu take neva do yu? Yu won still take my pikin mandrake too?” Rashel ansa, “Okay, make yu give mi some mandrake and e go sleep with yu dis nite.”
Dem nor gri follow di Oga dia God kommand, instead dem make two juju iron and one Asherah juju kon dey bow down to stars for sky and dey woship Baal juju.
E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.
instead, yu dey sin like Israel kings. Yu make Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem turn from God, just as Ahab family do for Israel. Yu still kill yor brodas and yor papa family wey betta pass yu.
Some of una nor dey beleful; even doh una dey chop betta grass, una still dey mash wetin una chop remain! Una dey drink klean wota kon dirty di ones wey una drink remain!
God kon tell mi, “Man pikin, yu dey si dat one too? All dis bad tins wey Judah pipol dey do and wey don spread for di land, nor do dem, but dem still dey do am for my Holy Place and e dey make mi vex for dem more-more. Si as dem dey curse mi for outside!
I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.
Una tink sey e nor mean anytin to God wey choose una among Israel pipol to dey near am, so dat una go fit serve am for en Tabanako kon stand and dey prish to di pipol?
Wen di Oga una God take una enter di land wey una go-go stay, E go porshu many kountries komot for una. Kontries like: Hit, Girgash, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol. (Di pipol for dis seven kountries get pawa pass una.)
But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.
Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
So di five men kon go Laish town and dem si sey, di pipol for der dey live dia life well like Sidon pipol; dem dey peaceful and save. Di pipol get money well-well, bikos di land dey produce betta food. Dem dey stay far from Sidon pipol and dem nor dey fight with anybody.