23 So for di thirty-first year wey Asa don dey rule Judah, Omri kon bi king for Israel and e rule for twelf years. Na from Tirzah e for rule for di first six years
Wen King Baasha hear wetin happen, e pak en sojas from Rama kon go Tirzah.
At last doz wey dey Omri side kon win, bikos Tibni die and Omri kon bi king.
For di thirty-eight year wey Asa don bi king for Judah, Ahab wey bi Omri pikin kon bi king for Israel and e rule from Samaria for twenty-two years.
For di twenty-sixt year wen Asa don bi king for Judah, Elah wey bi Baasha pikin kon bi king for Israel and e rule from Tirzah for two years.
Ahazaya na twenty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for one year. En mama name na Atalaya wey bi King Omri for Israel grand-pikin.
Ahazaya na twenty-two years wen e start to rule and e rule for one year from Jerusalem. Na Atalaya wey Omri born bi en mama.