Dem win all di towns near Gerar, bikos God make dis towns run with fear. Judah men karry dia propaty go house, bikos di propaty for di towns many well-well.
Di king tell Judah pipol, “Make wi build wall round dis town kon put towa and strong gate. Di land na awa own, bikos wi dey always obey and do wetin God wont.” So, dem kon build di towns and evritin kon dey go well for dem.
Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.