All di pipol for di town bigin kry as David with en men dey go. Di king with en men wey dey follow am kon cross go Kidron Valley as dem waka face di wildaness.
Batsheba go meet di king, make e for tell am wetin Adonijah tok. Di king stand up, bow greet en mama, den e sidan for en throne kon bring anoda chair for en mama make e for sidan for en rite side.
E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
E remove Asherah juju pole from God Temple kon burn am outside Jerusalem for Kidron Valley. E burn am to ashes kon trow am put for where dem for dey beri pipol.
E give orda sey make dem distroy Baal juju kon skata di incense altar wey dey on-top dem. E skata and grind Asherah juju, di oda juju and dia image, den e pour dia dust on-top di juju savant graves.
I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
But if anybody still get di mind to lie sey e dey profesai, na en own papa and mama go tell am sey, ‘Na deat go bi yor own, bikos yu dey lie with God name.’ Den if e still profesai, en papa and mama go shuk am die with swod.
But wen I si sey dem nor dey do wetin dem rite for God word, I kon tell Pita for dia front, “If yu wey bi Jew, dey do like Gentile pipol, how yu wont take make Gentile pipol live like Jew pipol?”