Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 14:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Yu don sin pass doz wey rule before yu. Yu don rijet and make mi vex, bikos yu make juju and image kon dey serve dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 14:9
42 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”


God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”


Judah pipol sin well-well and dem kon make God vex pass as E vex for dia grand-grand papa.


At wons, e bigin kill all Jeroboam family. So dat wetin God tok thru Profet Ahijah from Shiloh, go happen. Dem kill evribody for Jeroboam family and no one remain.


Dis tin happen, bikos Jeroboam make di Oga wey bi Israel God vex, with di sins wey en and Israel pipol kommit.


E nor obey God at-all and e make Israel pipol sin, just as Jeroboam do.


King Omri sin worse pass di sin wey doz wey don rule before am, do.


En own sin against God, worse pass all di pipol wey don rule before am.


E nor only kommit sin like Jeroboam, but e go marry Jezebel wey bi King Etbaal for Sidon, pikin and Ahab still dey woship Baal.


E still build Asherah juju. Di tins wey e do, make God vex pass wetin all di oda kings for Israel don do before.


E ribuild di high place dem wey en papa Hezekaya bin distroy; e build altars for Baal juju kon make Asherah juju, just as King Ahab do for Israel. E dey bow and woship stars for sky.


Plus all dis ones, God still dey vex for Judah, bikos of all di wiked tins wey Manasseh do.


But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.


King Jeroboam appoint en own priest dem to dey serve for di woship place and for di juju altar wey e make.


E sakrifice en sons for fire for Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and for der, doz wey don die, dem dey koll dia spirit kom back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wiked and bad tins wey make God vex.


Yor pipol seize strong-strong towns; betta-betta land; house wey propaty full; well wey dem don dig; olive trees; fruit trees and vineyards. Dem chop anytin wey dem wont kon fat and dem enjoy all di good tins wey Yu give dem.


But with all dis tins, di pipol go against Yu. Dem nor gri obey Yu and dem turn from yor law. Dem kill di profets wey kom warn and tell dem to turn kom meet Yu. Dem curse Yu many-many times,


Dem make God vex with all dis tins, so wahala and diziz kon attack dem.


Una nor gri listin to my kommand, instead una dey do my word anyhow like dirty.


Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.


But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God and dem nor gri obey en laws.


Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods; dem really make God jealous with dia juju.


Yu don show betta love to many-many pipol and Yu don still ponish pipol, bikos of dia papa and mama sin. Yu bi great God wey get pawa well-well and Yu dey rule evritin.


Dia shidren dey gada firewood; men dey make di fire and di wimen dey mix flower wey dem go take bake kake for dat juju wey dem dey koll, ‘Heaven Kween.’ Dem still dey pour wine give oda gods as ofrin and dis tin dey make mi vex.


But nobody among una dey listin or hear dem. Instead, una sturbon and wiked pass una grand-grand papa.”


Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Bikos yu forget and turn from mi, yu go sofa for yor ashawo life.”


God kon tell mi, “Man pikin, yu dey si dat one too? All dis bad tins wey Judah pipol dey do and wey don spread for di land, nor do dem, but dem still dey do am for my Holy Place and e dey make mi vex for dem more-more. Si as dem dey curse mi for outside!


Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.


Make una nor woship juju or make juju with iron. Na mi bi di Oga una God.


Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?


Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.


Una don dey sin against di Oga una God rite from di first day wey I know una!


Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ