Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 14:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 14:19
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jeroboam rule for twenty-two years. E die and dem beri am. So, Nadab, en pikin kon take-ova as king.


Evry oda tin wey Nadab do, dem rite am for Israel kings history book.


Evry oda tin wey Elah do, dem rite am for Israel kings history book.


Evry oda tin wey Zimri do and how e plan against pipol, dem rite dem for Israel kings history book.


Evry oda tin wey Omri do, dem rite am for Israel kings history book.


Evry oda tin wey Baasha do, dem rite am for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book.


Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.


Evry oda tin wey Jehu do, plus all en mighty-mighty works, dem rite dem put for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Jehoahaz do, plus all wetin e get, dem rite dem for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Jeroboam do, plus all wetin e get and en viktory wey make Israel take-ova Damaskus and Hamat, dem rite all for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Zekaraya do, dem rite am for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Shallum do, plus all en plans, dem rite dem put for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Menahem do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Pekahaya do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.


Di remainin tins wey Pekah do, plus all wetin e get, dem rite am put for Israel kings history book.


Joab wey en mama na Zeruaya kon bigin kount di pipol, but e nor komplete am. God kon ponish Israel for wetin dem do, so dem nor fit rite di real nomba for King David own book.


Dem rite Israel pipol name akordin to dia family for Israel kings history book. Dem karry Judah pipol go sofa for Babilon, bikos of dia sins.


Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.


Di remainin tin wey King Amazaya do wen e dey rule, dem rite dem for Judah and Israel king history book.


Di remainin tins wey Manasseh do, with how e pray to God and di profesy wey dem use God name take tell am, dem rite dem put for Israel kings history book.


Thru-out dat nite, di king know fit sleep, so e sey make dem bring di ofisas rekord book for di kingdom kom, den dem kon bring and read am for am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ