14 “God go put king for Israel wey go end Jeroboam throne.
Na God give Profet Jehu di message wey e tok against King Baasha and en family, bikos of di sin wey dem kommit. Nor bi only en wikedness dey make God vex, but na bikos e kill evribody for Jeroboam family.
But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.
Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad.
My brodas and sistas, make una nor dey komplain about each oda, so dat dem nor go judge una, bikos God wey bi di judge, stand near di gate.
and dis tishas go deceive una with dia wayo. God don kondemn dem tey-tey and Christ wey go distroy dem, nor dey sleep.