All di pipol for Israel go mourn and beri am. Na only en dem go beri well for Jeroboam family, bikos na only en di Oga wey bi Israel pipol God, dey happy with.
Elijah tell di king, “Dis na wetin God tok, ‘Wetin make yu send pipol go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos yu tink sey Israel pipol nor get God wey yu fit ask? Bikos of dis, yu nor go stand from di bed wey yu dey so and yu must die.’ ”
Dem ansa, “One man tell us, ‘Make una go back go tell di king sey, “Dis na wetin God tok: Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God? So di king nor go stand up from di bed wey e dey so, bikos e go die.” ’ ”