I go still bring some food kom make una chop, so dat una go get pawa to kontinue una journey. Una don respet mi to kom my house, so make I serve una.” Dem kon ansa, “Tank yu; wi gri.”
Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
Wen I nor ansa, Nebuzaradan kon sey, “Make yu go back go meet Gedalaya wey Shafan pikin, Ahikam born, bikos na-im Babilon king don choose as rulers for Judah. Yu fit stay with en and di pipol or yu fit still go anywhere wey yu like to go.” Den e give mi gift and some food kon sey make I dey go.
God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.