6 King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.
Den Fero koll Moses and Aaron kon tell dem, “Make una pray to God make E remove all di frog from mi and my pipol and I go allow una go sakrifice to am for di wildaness.”
So King Zedekaya send Jehucal wey Shelemaya born and Priest Zefanaya wey bi Maaseaya pikin sey make dem kom tell mi make I pray make God kom help awa pipol.
Den di pipol go meet Moses kon sey, “Wi don sin, bikos wi don tok against God and yu. Make yu pray to God make E take di snake komot from where wi dey.” So Moses kon pray for di pipol.