Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 13:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 13:2
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos all di tins wey God kommand, wey e tok against di altar for Bethel and di place wey dem for dey woship for Samaria town, must happen.”


Josaya na eight years wen e start to rule and e rule for thirty-one years from Jerusalem.


For di eight years wen e dey rule, even doh e still dey yong, e start to serve God wey en grand-grand papa David serve. For di twelft year, e bigin distroy all di place where dem for dey serve juju: Asherah juju and all di oda juju.


Heaven and eart, make una listin to wetin God tok: “Di shidren wey I train by mysef don turn against mi.


“True-true, di tins wey I bin tok, don happen naw. So, I go tell una new tins naw, even before dem go start to happen.”


I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am.


God sey, “Make una shaut well-well! Make una tell Israel wey bi my pipol about dia sins!


God first tok to Jeremaya for di thirtint year wen Amon pikin, Josaya dey rule Judah.


Judah land, Judah land, Judah land! Make una listin to wetin God won tok:


God sey, “Man pikin, make yu tell Israel mountin sey make dem listin to di message wey mi


So di mountins, hills, rivers and valleys, make una listin to wetin mi God wey get pawa dey tell una. Aldo sey una towns skata naw and oda nashons dey curse and laf una,


I go turn am round; hook en jaw kon drag en and en plenty sojas.


Jesus ansa, “I tell una true word, if dem kwayet, even stones go start to dey shaut!”


Heavens make una listin to mi as I dey tok; eart make una listin to di words wey I won tok so.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ