1 Kings 13:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
11 Dat time, e get one old profet for Bethel. E shidren kom tell am wetin di profet wey kom from Judah do for Bethel and di tins wey e tell King Jeroboam.
Di king kon sey, “Make una nor skata or tosh en grave! Make nobody disturb am at-all.” So dem leave di profet grave, plus all di oda profets for Israel wey dem beri for der.
For dat day wey God go judge evribody, many pipol go sey, ‘Oga God, wi use yor name prish God message, drive many demon komot from pipol body and do many mirakle.’