10 Dem ansa, “Yu go tell dem, ‘I wiked and hard pass my papa, Solomon!’
Yu go still tell dem, ‘My papa give una hard work do, but I go make di work hard pass as e bi before. Na ordinary kane e take flog una, but na koboko I go take dey flog una!’ ”
“Wetin una wont make I do? Wetin I go tell dis pipol wey sey make I sorry for dem?”
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
Pesin pride go distroy am, but if e dey honbol, pipol go respet am.
I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.