Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 11:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 E bigin woship Astarte wey bi Sidon pipol juju and Milkom, di yeye god wey Ammon pipol dey serve.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 11:5
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go do dis tin, bikos Solomon rijet mi kon bigin woship oda gods. E dey woship Astarte wey bi Sidon juju; Kemosh wey bi Moab pipol god and Milkom, wey Ammon pipol dey serve. Solomon nor obey mi; e dey do bad tins and e nor keep my laws and kommand, just as David en papa keep am.


E sin and e nor woship God, just as en papa David woship am.


For di east side for Jerusalem hill, e build where dem for dey woship Kemosh, wey bi Moab pipol yeye god and Milkom, wey bi Ammon pipol god.


Di king skata all di high place for Jerusalem east and Distroshon Mountin for sout, wey King Solomon build for Sidon pipol juju, Astarte and Kemosh di ashawo juju for Moab pipol, plus Ammon pipol juju wey bi Milkom.


Dem nor tink or rizin sef sey, ‘I dey burn some of di wood take bake bread and roast meat chop. Yet, I dey use dis same wood make juju and woship am?’


“ ‘Make una nor give una pikin as ofrin to Molek juju, bikos e go disgrace Oga God name.


bikos dem klimb on-top dia house go bow for di sun, moon and stars. Dem dey klaim sey dem dey follow God, but dem still dey woship Molek juju.


Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.


Israel pipol sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal.


Dem forget God kon dey serve Baal and Ashtoret image.


Den Israel pipol kry to God sey, ‘Wi know sey wi don sin, bikos wi don forget Yu and wi dey serve juju and Ashtoret image. Abeg! Make Yu kom save us from awa enemies hand and wi go serve Yu forever.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ