Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 11:38 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

38 If yu obey and follow my laws and yu win my heart as yu dey obey my kommand, just as David my savant do, I go always dey with yu. I go make yu king for Israel and I go make sure sey yor shidren-shidren go rule afta yu, just as I do for David.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 11:38
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bad pipol dey opress dem since dem kom dis land, but e nor go happen again. I promise sey, I go make yu win all yor enemies and I go give yu many shidren.


En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”


Jeroboam; I go make yu king for Israel and yu go rule all di aria wey yu wont.


Bikos Solomon sin, I go ponish David shidren-shidren, but I nor go ponish dem forever.’ ”


Wen Solomon don old, e kon stop to follow God, unlike David en papa wey follow God until e die.


And if yu obey and keep my laws and kommand, just as David yor papa do, I go give yu long life.”


“But for dis temple wey yu dey build, If yu obey all my laws and kommand, evritin wey I promise yor papa David, I go do dem for yu.


wen I choose pipol to dey judge dem. I go distroy all yor enemies.’ I pray sey, ‘Mi di Oga yor God go give yu many shidren wey go bi kings.


Bikos di nurse dem dey fear God, Oga God kon give dem dia own family.


And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.


“God wey dey mighty sey, ‘If yu obey my laws kon keep my kommands, na yu go bi oga for my temple and for my kourt and I go add yu join all dis angels wey dey my side naw.’


Make una nor chop di blood, so dat evritin go dey well with una and una shidren-shidren and if una do like dat, belle go sweet God.


Una go receive dis blessing if una really obey dis kommand wey I dey give una.


God go-go for yor front. E go dey with yu; E nor go leave or forget yu. Make fear nor katch yu and make di work nor taya yu.”


Nobody go fit stop yu still yu die. I go dey with yu as I dey with Moses. I nor go forget or leave yu.


Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ