“ ‘But I nor go take all di kingdom from Solomon. I go make am rule till e die. Dis na wetin I go do, bikos of David my savant, wey I choose and e obey my laws and kommand.
Wen all Israel Pipol hear sey Jeroboam don kom back from Egypt, dem invite am kon make am king for Israel. So, na only Judah tribe kon dey obey David shidren-shidren.