All Rehoboam wife na eighteen and en girl-friends na sixty. E born twenty-eight sons and sixty dotas. Na Absalom pikin, Maaka e like pass among en wifes and girl-friends
And before today go end, di ofisas for Persia and Media wifes go hear dis tin wey Kween Vashti do so and dem nor go ever respet and fear dia husband again.
Silva, golds and oda good tins wey I karry from oda kings and nashons, I still save dem for mysef. I hire good singas, both men and wimen and I get many fine-fine girl-friends. Yes! I get evritin wey suppose make man happy!
na-im bi di only one wey I love and e fine like dove. Na-im bi di only girl wey en mama born and en mama like am well-well. So evry woman dey bless am; even di kweens and my girl-friends dey praiz am.
Den e go en papa house for Ofrah kon kill en step brodas, di 70 son wey Gideon born. E kill all of dem on-top one stone. But na only Jotam wey bi Gideon last born, run bikos e hide.