20 Hadad wife born boy, so e name am, “Genubat”, but na di kween kare for am for di palis and e stay with di king shidren.
Sarah still sey, “Na who for fit tell Abraham sey Sarah go ever born pikin? Yet I don born boy for am for en old age!”
Hadad kon bi di king friend, so di king gi-am en wife sista, make e marry. (Di king wife name na Tahpanhes.)
Wen Hadad hear for Egypt sey King David and Joab en soja kommander don die, Hadad kon tell di king, “Make I kon dey go back to my own kountry.”
So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.