Profet Jehu wey bi Hanani pikin go meet di king kon sey, “E dey good make wi help and follow wiked pipol wey hate God? Wetin yu do so, don make God dey vex for yu.
Una land go start from di Red Sea go rish Filistia pipol sea and from di wildaness go rish di river. I go give una di pipol wey dey di land and una go drive dem komot from der.
Judah pipol don break dia promise wey dem make with God kon dey do wiked tins for Jerusalem and evriwhere for di land. Dem don dirty di temple wey God love and dia men marry wimen wey dey serve juju.