1 Kings 11:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
17 but na only Hadad with some of en papa savant wey bi Edom pipol, naim dem nor kill, bikos dem run go Egypt and dat time, Hadad still bi small pikin.
Mefiboshet wey bi Jonatan pikin and Saul grand-pikin, na five years e bi wen di news kom from Jezrel sey dem don kill en grand-papa Saul and Jonatan en papa for war. Den en nurse kon karry am dey run, but bikos e dey hurry, di pikin fall from en hand, so en leg kon break.
Hadad and di men wey karry am run kon from Midian go Paran, where oda men for join dem. Den, dem travel go Egypt and Egypt king kon give Hadad some land, house and food.
So King Joram dota, Jehosheba, wey bi Ahazaya sista, eskape with Ahazaya pikin, so dem nor kill-am with di oda king shidren. Jehosheba keep di boy with en nurse for one room where dem dey keep tins inside di temple, so dat Atalaya nor go fit si and kill-am.