Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 11:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 So God kon make Hadad wey dey di royal family for Edom, turn against Solomon.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 11:14
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God kon dey vex for Israel pipol again and E make David bring trobol kom meet dem. God tell am, “Make yu go kount Israel and Judah pipol.”


I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin.


But I nor go take di whole kingdom from am. Instead, I go leave one tribe for am bikos of David, my savant and bikos of Jerusalem, di town wey I dey stay.”


Before dis tin happen; for di time wen David win Edom pipol, Joab wey bi en sojas kommander bin go beri dead body.


God still make Rezon wey bi Eliada pikin, turn against Solomon. Rezon run from en oga, King Hadadeza for Zobah


Na so God wont make e bi, so dat wetin E tell Profet Ahijah for Shiloh sey make e tell Nebat pikin, Jeroboam, go fit happen and na dis make di king nor listin to di pipol.


So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.


Mi, God wey get pawa, go use my kane take flog dem, just as I flog Midian pipol for Oreb Rock. I go ponish Assyria pipol, just as I take ponish Egypt pipol before.


God sey, “I dey use Assyria pipol as weapon to take ponish pipol wey I dey vex for.


God sey, “I go make Medes pipol attack Babilon pipol. Dem nor dey kare about silva and nobody fit tempt dem with gold.


E go take-ova Edom town and propaty; den Israel pipol go win.


So naw, make my oga di king listin to wetin en savant won tok. If na God make yu hate mi; if I offa ofrin to am, E go shange en mind, but if na human being make yu hate mi like dis, God curse go fall for dia head! Bikos dem don porshu mi komot from God land wen dem sey, ‘Make yu go. Go serve anoda god!’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ