Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
God tell Solomon, “Yu nor ask for money, propaty and honor, or pawa to revensh yor enemies or for long life, instead yu ask for wisdom and undastandin, so dat yu go fit rule my pipol well;
naw, wisdom and undastandin, na yor own. I go still give yu money, propaty and di kind honor wey pass evry oda king wey dey before and wey go dey afta yu.”
E get one man for dis yor kingdom wey get di holy gods spirit inside am. Di time wey yor papa, Nebukadnezzar bi king, naim dey kommand all di wise men for Babilon.