King Solomon use di wood take build rails for di temple and di palis. E still use am make harp and lyre for doz wey dey play music. Di junipa wood wey fine pass, na-im dem bring kom Israel and e nor get any oda wood like doz ones again.
So, make yu send somebody kom; pesin wey know how to work with gold, silva, bronze and iron, plus purpol, crimson and violet klot. Pesin wey fit design well-well. E go work with my men wey sabi karve tins for Jerusalem and Judah, bikos na David my papa train dem.
Make yu send cedar wood, evagreen and algum trees for Lebanon kon give mi, bikos I know sey yor savants sabi kut trees. My savants go work with yor savants,
Hiram send sheep and some pipol wey sabi kontrol sheep go meet am. Men wey know how to drive for sea. Dem drive with Solomon men go rish Ofir kon take 450 gold from der, den dem bring am kon give King Solomon.
Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!