But Joab ansa di king, “My king, make di Oga wey bi yor God make dem plenty hundred times pass as dem bi naw and yu go leave long kon si wen E go do am, but wetin make di king won kount di pipol?”
Di one wey worse pass bi sey, all di ofisas go meet David kon tell am, ‘God go make Solomon dey great pass yu and en reign go pass yor own ten times.’ Den King David bow woship God from en bed
Afta dem don waka pass, Elijah kon tell Elisha, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu, before God go take mi go heaven.” Elisha ansa, “Abeg! Make yu let mi get doubol of di pawa wey yu get.”
David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.
God ansa am, “True-true, I go dey with yu and dis go bi di sign to show sey na mi send yu: wen yu take di pipol komot from Egypt, yu and dem go kom serve mi for dis mountin.”
Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
But if really sey my papa get mind to kill yu, make God do all dis tin and many more to Jonatan if I nor kon tell yu, so dat yu go run go hide. Make God dey with yu, as E bin dey with my papa.