But e send message go give all di pipol wey dey Israel tribe sey, “If una hear trumpet sound, den make una shaut, ‘Absalom don bi Hebron pipol king!’ ”
Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am!
E don use many goat, sheep and fat melu take do sakrifice and e invite Abiatar di priest, yor shidren and Joab wey dey kommand yor sojas, but e nor invite Solomon.
For dat time, Adonijah wey Haggit born for David kon dey boast dey sey, “Na mi go bi king!” So e buy plenty horse with pipol wey go dey drive dem and with fifty men wey dey escort am.