Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am!
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
den yu go still fit break di kovenant wey I make with my savant David and Levi tribe wey sey, ‘Kings go always kom from David family and na Levi family go always bi priests.’