11 Den Natan go meet Batsheba wey bi Solomon mama kon ask, “Yu neva hear sey Haggit pikin, Adonijah, don make ensef king? And David nor know anytin about am!
But e send message go give all di pipol wey dey Israel tribe sey, “If una hear trumpet sound, den make una shaut, ‘Absalom don bi Hebron pipol king!’ ”
Den Adonijah, wey en mama na Haggit, go meet Batsheba, Solomon mama and di woman ask am, “Dis na betta visit so?” Adonijah ansa, “Yes! Na betta visit.”
King David tell all di pipol, “Na Solomon my pikin God choose, but e still dey yong and e neva sabi many tins. Di work wey dem won do dey hard, bikos dis nor bi palis for man, but na temple for di Oga awa God.